Seven Last Plague dem
The people wey refuse the beast stand near one sea wey be like glass, dey sing Moses song and the Lamb song, dey talk say our Papa ways dey correct and true. Seven angel comot wear shiny linen, carry seven bowl, and smoke full the temple so nobody fit enter until dem pour the bowl dem finish.
15 1I see anoda sign for heaven, e big well-well and e make person wonda: seven angel dey hold di seven last plague dem, because na inside dem di vex of our Papa take end.
2I see somtin wey be like sea wey dem make with glass wey mix with fire, and di people wey don win di beast, im image, and di numba of im name, dey stand for im side, dey hold harp wey come from our Papa. 3And dem sing di song of Moses, di servant of our Papa, and di song of Jesus, di Lamb: “Di tins wey you do big well-well and dem make person wonda, O Papa, di Oga wey get all power! Di way wey you dey do tins dey correct and dey true, King of all di nation dem! 4Who no go fear you, O Papa, and give your name glory? Because na only you holy. All di nation dem go come and worship for your front, because dem don show di correct-and-holy tins wey you do.”
5Afta dis, I look, and di temple, di tent of testimony, open for heaven. 6Di seven angel wey get di seven plague dem comot from di temple, dem wear clean linen cloth wey dey shine, and dem tie gold band for dem chest.
7Den one of di four living creature dem give di seven angel seven gold bowl wey full with di vex of our Papa, wey dey live foreva and eva. 8Smoke wey come from di glory of our Papa and from im power full di temple; nobody fit enta am until di seven plague dem of di seven angel end.