No Person Dey Do Good
For di director of music, according to Mahalath. A wisdom psalm wey David write.
E almost be di same as Psalm 14. Our Papa look all humanity to find one person wey understand, and e no find any. Di people wey dey swallow im people, fear catch dem where nothing dey to fear. E end as e dey long for salvation wey go comot from Zion.
53 1Di foolish person talk for im heart sey, "God no dey." Dem don spoil, dem dey do wickedness wey pass person eye; no person dey do good.
2Our Papa look down from heaven on all human being to see if any person dey wey get sense, any person wey dey find am. 3Dem all don comot for di way; dem join body don spoil; no person dey do good, no even one.
4Abi di people wey dey do evil no get sense—dem wey dey chop my people finish as dem dey chop bread, and dem no dey call our Papa? 5For dia dem full with fear well-well, for where nothing dey wey person suppose fear; because our Papa scatter di bone of di person wey come camp against you; you put dem for shame, because our Papa don reject dem.
6Ah, make salvation for Israel comot from Zion! When our Papa bring back di better tin of im people, make Jacob rejoice, make Israel dey glad.