Where Revelation No Dey
About rulers, temper and pikin. When righteous people dey flourish, the people dey happy, and when wicked people rule, dem dey groan. Fool dey pour out all im vex, and person wey dey talk quick-quick worse pass fool. Where revelation no dey, people go dey run wild.
29 1Person wey dem dey correct plenty times but e still refuse to hear go suddenly break finish wey no fit heal again. 2When correct-and-holy people dey flourish, di people dey rejoice, but when wicked people dey rule, di people dey groan. 3Man wey love wisdom dey bring joy give im papa, but person wey dey follow ashawo dey waste im money. 4Through justice king dey give land stability, but person wey greedy for bribe dey scatter am. 5Man wey dey sweet-mouth im neighbor dey spread net for im own leg. 6Bad man dey trap by im own sin, but correct-and-holy people dey sing and rejoice. 7Correct-and-holy people dey care about justice for poor people, but wicked people no get dat kind understanding. 8People wey dey mock dey set city on fire, but wise people dey cool di anger down. 9When wise man go court with foolish person, di foolish one go dey vex and dey laugh am, and peace no dey. 10People wey dey thirst for blood dey hate person wey no get blame, and dem dey find way to kill di correct-hearted person. 11Foolish person dey pour out all im anger, but wise man dey hold am back and dey keep imself calm. 12If ruler dey hear lie, all im officials go turn wicked. 13Poor man and di person wey dey oppress get dis one thing together: our Papa dey give eye-sight give di two of dem. 14If king dey judge poor people with fairness, im throne go stand strong forever. 15Cane and word of correction dey give wisdom, but pikin wey dem leave to imself dey bring shame give im mama. 16When wicked people dey flourish, bad-bad wey dem dey do dey flourish too, but correct-and-holy people go see how di wicked one go fall. 17Discipline your pikin, and e go give you peace; e go bring sweetness give your heart. 18Where revelation no dey, di people dey run wild, but blessing dey for person wey dey keep di law. 19You no fit correct servant with word alone; even though e understand, e no go obey. 20You see man wey dey rush im mouth? Hope dey for foolish person pass am. 21If you pet servant from small time, for di end e go turn like person wey go collect inheritance. 22Man wey dey vex dey cause quarrel, and man wey dey quick to anger dey commit plenty sin. 23Man im pride dey bring am down, but person wey get humble spirit dey gain honor. 24Person wey dey join hand with thief na im own enemy; e dey hear di curse but e no dey talk anything. a a v24 Di 'curse' na public oath wey dey demand say anybody wey see di crime must come out come testify. 25Fear of man dey set trap, but anybody wey dey trust for our Papa dey stay safe. 26Plenty people dey find ruler favor, but justice for person dey come from our Papa. 27Man wey no dey do justice na abomination give correct-and-holy people, and correct-hearted person na abomination give wicked people.