Hezekiah Im Collection
Na Hezekiah men copy am, and e full with comparison pass normal: apple of gold, snow for harvest time, bad tooth, vinegar for soda, city wey no get wall. Im advice dey clear, from make you no push yourself forward for king front reach make you no stay too long for your neighbor house.
25 1Dis ones too na di proverbs of Solomon, wey di men of Hezekiah wey be king of Judah copy comot. 2Na di glory of our Papa to hide one matter, but na di glory of kings to search one matter comot. 3Just as di heavens high and di earth deep, na so di heart of kings dey wey person no fit search am reach. 4Comot di dirty from di silver, and vessel go come out for di one wey dey refine am. 5Comot di wicked person from di king front, and im throne go stand strong for correct-and-holy way. 6No dey push yousef forward for di king presence, and no stand for di place of di big people; 7because e beta make dem tell you, “Come up here,” pass make dem put you for lower place for front of one big man wey your eye dey see. 8No rush enter quarrel, because wetin you go do for di end wen your neighbor put you for shame? 9Argue your case with your neighbor imsef, but no open anoda person secret, 10so dat di one wey hear am no go shame you, and your bad name no go ever comot. 11Word wey person talk for di correct time be like apple of gold wey dem set inside silver. 12Like ring of gold or fine gold ornament, na so wise correction be for ear wey dey listen. 13Like di cold of snow for harvest time, na so faithful messenger be to di people wey send am; e dey refresh di soul of im masters. 14Like clouds and wind wey no bring rain, na so person wey dey boast of gift wey e never give be. 15Na through patience dem dey convince ruler, and soft tongue dey break bone. 16If you find honey, chop only wetin reach you, if no be so you go chop too much and vomit. 17No dey go your neighbor house too much, so dat e no go tire for you come hate you. 18Like club, sword, and sharp arrow, na so di person wey dey give false witness against im neighbor be. 19Like bad tooth or foot wey comot for joint, na so to trust person wey no dey faithful for time of trouble be. 20Like person wey remove cloth for cold day, like vinegar wey dem pour for baking soda, na so di person wey dey sing song give heavy heart be. 21If your enemy dey hungry, give am bread make e chop, and if thirst dey catch am, give am water make e drink; 22because you go heap coals of fire for im head, and our Papa go reward you. 23Di north wind dey bring rain, and tongue wey dey gossip for secret dey bring vex face. 24E beta make person live for corner of di rooftop pass to share house with wife wey dey quarrel. 25Like cold water to soul wey don tire, na so good news from far land be. 26Like spring wey don muddy or fountain wey don spoil, na so di correct-and-holy person be wey give way for di wicked person. 27E no good to chop too much honey, and e no good to dey find your own glory. 28Like city wey dem don break enter and leave am without wall, na so di person wey no fit control im own spirit be.