Di Papa Dey Prepare di Road
John, wey wear camel hair, tell di crowd wey dey come for baptism say to come from Abraham line no dey save anybody. Then Jesus too ask make im baptize am, and John say na di oda way round e suppose be. Im allow am, and im Papa voice claim am as im Son wey E love.
3 1For dat time, John di Baptist come, dey preach for di wilderness of Judea, 2“Make una repent, because di kingdom of our Papa don near.” 3Dis na di one wey Isaiah di prophet talk about, wey e say: “Na voice dey cry for di wilderness: Make una prepare di road of Oga, make im paths straight.”
4John dey wear cloth wey dem make from camel hair, with leather belt for im waist; im food na locust and wild honey. 5Den Jerusalem and all Judea and all di area around di Jordan come out go meet am, 6and e baptize dem for Jordan River, as dem dey confess dia sin.
7As e see plenty Pharisee and Sadducee dey come make e baptize dem, e tell dem, “Una pikin of snake! Na who warn una make una run comot from di anger wey dey come? 8So, make una bear fruit wey fit show say una don truly repent. 9No think say una fit tell unaself say, ‘Abraham na our papa,’ because I dey tell una: our Papa fit raise pikin for Abraham from dis stone dem. 10Dem don put di axe for di root of di tree dem, so any tree wey no dey bear good fruit, dem go cut am comot throw am inside fire.
11“I dey baptize una with water for repentance, but di one wey dey come after me strong pass me—I no even fit carry im sandal. E go baptize una with the Holy Spirit and fire. 12Im winnowing fork dey im hand; e go clear im threshing floor, gather im wheat put inside barn, but e go burn di chaff with fire wey no dey ever quench.” a a v12 Dem dey use winnowing fork throw di grain wey dem don thresh go up for air; di wheat wey heavy go fall back for ground, while di chaff wey light go blow comot.
Di Papa Welcome im Pikin
13Den Jesus comot from Galilee go meet John for Jordan, make John baptize am. 14But John try stop am: “Na you suppose baptize me, why you come meet me?”
15Jesus answer am, “Allow am now, because na so we go take fulfill all correct-and-holy way.” So John allow am.
16After dem baptize Jesus, e comot from di water sharp-sharp, and one time di heaven open for am; e see di Spirit of our Papa dey come down like dove come rest on top am.
17Den one voice from heaven talk say, “Dis na my Pikin, di one wey I love; my belle dey sweet for am.”