Di Wicked People and Dia Ways
For di director of music. Na psalm wey David, di servant of our Papa, write.
E open inside wicked man mind, where e dey flatter imself so tey e no fit see im own sin. Against dat tight self-talk, di psalm open out to our Papa: love wey reach di clouds, righteousness like mountains, river of delight, light wey we dey use see light.
36 1Rebellion dey talk to di wicked man well-well for inside im heart; fear of our Papa no dey before im eye.
2Because e dey sweet-mouth imsef for im own eye so much sey e no fit see im sin or hate am. 3Di words wey comot for im mouth na wickedness and deceit; e don stop to dey do wise tin and to dey do good. 4Even for im bed e dey plan wickedness; e put imsef for road wey no good; e no dey reject wetin be evil.
5Our Papa, your Covenant love reach up to di heavens, your faithfulness reach di clouds. 6Your correct-and-holy way be like di mighty mountains, your judgments be like di deep wey deep well-well; you dey save people and animals, our Papa. 7How your Covenant love take dey precious, our Papa! All people dey hide for inside di shadow of your wings. 8Dem dey chop belleful for di plenty tin wey dey your house, and you dey give dem water to drink from di river of di tins wey sweet you. 9Because na for your side di fountain of life dey; for inside your light we dey see light.
10Continue to show your Covenant love to dem wey know you, and your correct-and-holy way to dem wey get correct heart. 11No let di leg of di proud man step on top me, no let di hand of di wicked man drive me comot. 12Na dere di evil-doers don fall; dem throway dem for ground, dem no fit stand up again.