From Dust Reach Princes Table
113 1 Hallelujah! Praise am, una wey be servants of our Papa; praise di name of our Papa. 2 Make di name of our Papa bless, from now go reach forever. 3 From wia di sun dey rise reach wia e dey set, make dem praise di name of our Papa. 4 Our Papa dey high pass all di nations, im glory dey pass di heavens. 5 Who be like our Papa, wey dey sidon for up high, 6 wey dey bend down look di heavens and di earth? 7 E dey lift di poor comot for inside dust E dey raise di person wey no get from di ashes heap, 8 make dem sidon with princes, with di princes of im people. 9 E dey give di woman wey no get pikin place for her house, as mama wey im belle sweet am with pikin dem. Hallelujah!