Majesty Cover Am Like Cloth
93 1 Our Papa dey reign; majesty cover am like fine cloth. Our Papa wear cloth; strength na wetin e take gird imsef. Yes, di world stand firm well-well; nothing fit shake am. 2 Your throne don stand since ancient time; you dey from before before wey no get end. 3 Di flood don rise, our Papa; di flood don raise dia voice; di flood dey raise dia waves wey dey pound. 4 Pass di thunder of plenty water, pass di big waves of di sea, our Papa for up high get power pass all of dem. 5 Your laws sure well-well; holiness dey make your house fine, our Papa, forever and ever.