Our Papa Talk
Dem draw the border of Canaan — for south from Zin wilderness, for west na the Mediterranean Sea, for north reach Hazar-enan, for east e follow Jordan go down reach the Dead Sea — and dem name one leader from every tribe to share the inheritance with Eleazar and Joshua.
34 1And our Papa talk give Moses, say,
2"give order to di Israelites: wen una enter di land of Canaan, na dis be di land wey go fall to una as inheritance—di land of Canaan, inside im borders. 3Una south side go run from di Zin wilderness for Edom side; una south border go start from di Dead Sea end, for east side. 4Una border go turn for south of di Ascent of Akrabbim, cross go Zin, reach south of Kadesh-barnea, go on reach Hazar-addar, and pass reach Azmon. 5From Azmon di border go turn go Egypt Brook, and e go end for di Sea.
6"Una west border go be di Mediterranean Sea and im coast. a a v6 Di Great Sea na di Mediterranean.
7"Dis go be una north border: from di Mediterranean Sea, draw una line go Mount Hor. 8From Mount Hor mark line go Lebo-hamath, and e go end for Zedad; 9den di border go stretch reach Ziphron and end for Hazar-enan. Dis go be una north border.
10"Una go mark out una east border from Hazar-enan go Shepham. 11Di border go go down from Shepham reach Riblah, for east of Ain, den e go go down reach di slope for east of di Sea of Chinnereth. b b v11 Di Sea of Chinnereth na di lake wey dem come call Sea of Galilee later. 12Di border go go down reach di Jordan, and e go end for di Dead Sea. Dis go be una land, wit im borders all around."
13Moses give order to di Israelites: Dis na di land wey una go inherit by lot, wey our Papa command make dem give di nine tribes and di half-tribe. 14Di tribe of Reuben pikin dem, by dia papa house, and di tribe of Gad pikin dem, by dia papa house, don already take dia inheritance; na so di half-tribe of Manasseh too do. 15Di two-and-half tribes don receive dia inheritance for across di Jordan from Jericho, for east side wia sun dey rise.
Our Papa Talk Again
16And our Papa talk give Moses, say,
17"na dis be di names of di men wey go share di land give una as inheritance: Eleazar di priest and Joshua pikin of Nun. 18And una go take one leader from every tribe make dem share di land for inheritance. 19Dis na di names of di men: from di tribe of Judah, Caleb di pikin of Jephunneh; 20from di tribe of di pikin dem of Simeon, Shemuel di pikin of Ammihud; 21from di tribe of Benjamin, Elidad di pikin of Chislon; 22from di tribe of di pikin dem of Dan, one leader, Bukki di pikin of Jogli; 23from Joseph pikin dem: from Manasseh tribe, leader Hanniel pikin of Ephod, 24and from di tribe of di pikin dem of Ephraim, one leader, Kemuel di pikin of Shiphtan; 25from di tribe of di pikin dem of Zebulun, one leader, Elizaphan di pikin of Parnach; 26from di tribe of di pikin dem of Issachar, one leader, Paltiel di pikin of Azzan; 27from di tribe of di pikin dem of Asher, one leader, Ahihud di pikin of Shelomi; 28and from di tribe of di pikin dem of Naphtali, one leader, Pedahel di pikin of Ammihud."
29Dis na di ones wey our Papa command make dem share di inheritance give di children of Israel for di land of Canaan.